Ex-gang boss wey plan Tupac Shakur murder chop 40 years prison sentence

Former gang boss Duane "Keffe D" Davis don chop at least 40 years in prison say e order di murder of Tupac Shakur.
One jury find 63-year-old Davis guilty for September of one count of murder wit a deadly weapon for di rap superstar death for one drive-by shooting for Las Vegas for 7 September 1996. E say e go appeal di verdict.
Prosecutors argue say although Davis no fire di gun imsef, na im be di ringleader of di group wey commit di murder. E admit for im memoir say e bin provide di gun wey dem use for di crime.
Davis conviction na di first in a cold case wey hip-hop fans don chook eye for nearly 30 years.

Prosecutor Marc DiGiacomo argue during Tuesday sentencing hearing say Davis spend years dey publicly brag about im role for di Shakur death, wey e tok say get "wide-ranging effects upon di world".
Shakur sister, Sekyiwa Shakur, tell di court: "Di loss of Tupac, for a long time, cripple my family."
"E bin get so much promise, intentions for beta world," Sekyiwa tok and add say her brother bin hope to help im local community.
Sekyiwa Shakur bin ask di judge to give Davis di maximum sentence, and tell Davis say e go sit for prison and tink about "wetin e don do to di world, not just to me".
Shakur brother, Maurice Shakur, also address di court, and ask di judge for "di longest possible sentence".



No comments yet — be the first to share your thoughts.