Why Isa Patanmi, Adebutu and odas dey miss from Inec governorship candidates list
Kingsley Chinda Facebook, Alex Otti Facebook, Hamzat Facebook, Malami Facbook, Aishatu Facebook, Yusuf Abba Facebook

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don debunk one tori wey dey circulate for social media on top issues wey affect di list of governorship candidates for six states, wey include, Zamfara, Gombe, Delta, Plateau, Yobe, and Kano.
According to di tori, di electoral body don drop special announcement concerning di govnorship candidates wey dia name no make di final govnorship candidates list for di 6 February 2026 election, wey di commission release ova di weekend.
Di commission make am clear say dem no make any special announcement, say make pipo ignore di report.
"Di commission wish to categorically inform di general public say di publication na FAKE and e no originate from Inec," di electoral body tok for one statement on Monday, 12 October.
Dis clarification dey come afta di names of some prominent governorship candidate for di opposition party wey include and Ladi Adebutu of di Peoples Democratic Party (PDP) for Gombe and Ogun, alongside Aminu Abdussalam Gwarzo of di Nigeria Democratic Congress (NDC) for Kano state dey miss from di list.
For di statement, Inec no tok why dem comot di names of some of di candidates, BBC don reach out to dem for comment.
Di commission tok say di list wey include dis states; Zamfara, Gombe, Delta, Plateau, Yobe and Kano, "no originate from Inec."
Dem ask Nigerians make dem check dis official website and social media page for information while di commission ask Nigerians to remain vigilant and verify all electoral information through dia official communication channels to "avoid false or fraudulent publications.
Some of di governorship candidates wey dia names no dey on INEC final governorship list on Sunday don react.
Who be di govnorship candidates wey no make di list
Isa Pantami and Ladi Adebutu of di Peoples Democratic Party (PDP) for Gombe and Ogun, alongside Aminu Abdussalam Gwarzo of di Nigeria Democratic Congress (NDC) for Kano state, no dey di list.
Jungudo Haruna Mohammed PDP tok-tok pesin, tell di candidates say dem don engage wit Inec to try resolve di issue of di omission di names of dia governorship candidates from di final list of candidates wey go contest for di 2027 governorship elections.
E assure all di candidates say dem dey treat dia concerns wit "utmost seriousness and go communicate further developments as appropriate."
However, Pantami bin say di omission na temporarry challenges and normal part of electoral process and no be di final determination.
Suleiman Mohammed, tok-tok pesin to di former minister of Communications tok say dem dey aware some pipo dey work behind di scene to frustrate good and responsible leadership in Gombe State, but dia legal and liaison teams don dey engage wit di party leadership and INEC to ensure say dem rectify am.
Adebutu don tok assure im supporters im still be member of di PDP party and im go pursue di issue through di appropriate channels while insisting say make Inec respect di electoral process for im eligibility as PDP governorship candidate in Ogun State.
"We go pursue dis matta through di appropriate channels and insist say due process dey respected," e tok.
NDC don insist say na all di names of dia candidate wey go participate in di coming elections dem submit give Inec officials.



No comments yet — be the first to share your thoughts.