How gunmen enta church shoot pipo during burial service

Seven pipo dey killed for one attack during a funeral for central Jordan, officials say.

At least 34 odas dey injured as gunmen open fire on one church for Hmoud, in di Karak governorate on Friday.

Di unidentified gunmen dey reported to arrive in a car, enta di church and open fire bifor dem run comot.

No one don admit say dem carry out di attack.

For news conference, Interior Minister Mazen al-Faraya say authorities dey work to catch di perpetrators wey dem describe as "group of extremists".

Jordan King Abdullah II, say di authorities go "confront di terrorist act wey target Karak wit di harshest penalties".

Dozens of pipo dey inside di church for di funeral wen di shooting begin, Khaled Burqan, one of di mourners, tell Jordan al-Mamlaka state-run TV.

E say two attackers armed wit rifle and pistol dey fire at di mourners for several minutes.

Al-Faraya add say di incident dey "painful and horrific" and "unparalleled in di history of di Hashemite Kingdom of Jordan," during im news conference.

Public service television station al-Mamlaka don report say di king arrive for Karak on Friday evening "to check on di condition of di injured pipo".

How di attack take happun

Initial reports indicate say seven pipo dey killed for di attack. One govment tok tok pesin later say six pipo don die, bifor officials again revised di death toll to seven.

CCTV footage, verified by di BBC, appear to shows three gunmen making dia way from road toward di church.

Two of di attackers dey seen dia way on to wetin appear to be a vehicle entrance to di church grounds, bifior retreating briefly and returning wit third man. All three appear to be armed wit handguns.

Separate footage believe to be from di aftermath of di attack appear to show several dead and wounded bodies on di ground amid some chaotic scenes.

Comments

No comments yet — be the first to share your thoughts.